UGO AND UZO VIBE

Friday, 2 August 2013

OLD BUT GOLD

Akpors’ elder brother, Rukewe,
travelled to London months ago, leaving
behind Akpors, their aged mom & their pet cat, kelly.

Last week Rukewe called from London
to know how they’re doing…

RUKEWE: Akpors how una dey now, how
kelly?

AKPORS: Kelly done die.

RUKEWE (after a pause): Akpors u for
use small small reveal dis kin bad news
na. U for jus say d cat fall inside well
but neighbors de try comot am. Den
when I call again, u go say e break neck
small but vet doctor dey try revive am. Den when i call again, u go say dem try
their best but dem no fit save am. Na so
dem dey reveal bad news in a mature
way. u hear me?

AKPORS: Yes bros.

RUKEWE: Ok. how mama na?

AKPORS: Bros. mama sef fall inside well
o, but neighbors dey try comot am.

(Phone cuts)

Rukewe has been admitted in a private
hospital in London after going into
coma.

No comments:

Post a Comment